Wednesday 13 June 2012

BAYELSA PEOPLE MAKE WE TALK INTERVIEW SAINT MIENPAMO



MIENPAMO ONITSHA SAINT, CEO OF DE SAINT STUDIO AND POLITICAL ACTIVIST OF REPUTE SPEAKS TO BAYELSA PEOPLE IN THIS EXCLUSIVE INTERVIEW. YOU ARE WELCOME ONLINE, SIR






  • Bayelsa People - Make We Talk Bayelsa People dey happy as we get you as our guest today. Some dey ask whether dem born you for heaven as you come dey bear Saint. Anyway, make we no put word for your mouth. Tell us just small about your background, wetin you dey do before and wetin you dey now, make we continue from there? Make we talk.

  • Mienpamo Onitsha Saint
    I thank una very much 4 inviting me to join una 4 dis honourable interview today. Anyway. Na me get DE SAINT STUDIO 4 bayelsa state and I don teach plenty bayelsa upcoming artist how to sing song and also do DJ work for the state. Dat na fo...See more


  • Bayelsa People - Make We Talk Hmmmn. You be strong Bayelsa man. Tell us about the Face of Bayelsa. Wetin be the main work wey Face of Bayelsa dey do for Bayelsans.

  • Mienpamo Onitsha Saint My brother. FACE OF BAYELSA. Na the place we the government of bayelsa dey stay. Na there me, you, my mama and papa. And your mama and papa and all the good people and friends of bayelsa dey stay dey discouse about the problem and solution of bayelsa state. We also have a charity platform were we dey go help school children and other orphan home. They thing wey we dey do most na for good governance in bayelsa state

  • Mienpamo Onitsha Saint using the social media for good governance

  • Bayelsa People - Make We Talk Una do well o! We hear say una to jolly for Port Harcourt and Abuja last month or so. And as una return, you come dey bear new name. Why na, all of us dey Bayelsa na im only Face of Bayelsa come go waka alone. Abeg give the true story. Make we talk.

  • Mienpamo Onitsha Saint
    Thank you very much for dat think wey u just ask me. Make I start with the PH waka. The PH waka no be me or face of bayelsa waka. Na waka wey bayelsa state government sponsor thro the SSA on new media and research DR JOHN IDUMANGE. The ssa ...See more


  • Bayelsa People - Make We Talk Although we no been dey there, but the thing sweet all of us for belle. But before una go for the Abuja waka, Bayelsa New Media no been dey Bayelsa. Abeg tell us about this Bayelsa New Media way dey reign now.

  • Mienpamo Onitsha Saint
    Bayelsa new media was formed during the abuja conference. By the governor and we'll meaning nigerians like the inec chairman. PROF JEGA. We did dat bcos we don't want to waist what we have learn do far from the conference. Dem teach us how ...See more


  • Bayelsa People - Make We Talk Thank you my brother. In fact before we continue we wan give out three gbosa! one for HSD, one for Idumange and one for you. Oya take am Gbosa! Gbosa!! Gbosa!!!

  • Bayelsa People - Make We Talk We dey jolly in advance as SSA media include one of our own Comrade Robinson Erebi among the 200 people wey HSD go bless on 23rd June. Now make we take the role wey all these people go play for this Bayelsa New Media as e be say most of dem dey for other groups or e dey operate social media on their own?

  • Mienpamo Onitsha Saint My brother. You cannot move a moving plan to his direction without a professional pilot on it. Bayelsa state government want to make this bayelsa new media team to supper see all the groups on social media and carry along every body. As you can see. Everybody have equal right on bayelsa new media team. So pls. All contributions to make it grow is valid for ever

  • Bayelsa People - Make We Talk True talk my brother. And we dey happy well well to be part of dis fine idea wey come with Bayelsa New Media. Now make we talk small about HSD. How you take see im government?

  • Mienpamo Onitsha Saint
    HSD. Dey try. For three month as a governor of bayelsa state. The man don save plenty money wey reach 23billion. And him also find out money wey the pass government dey thief sake of say dem dey use am pay salary from 5billion to 3.8billion...See more

No comments:

Post a Comment

WELCOME TO BAYELSA NEW MEDIA TEAM, WE GIVE YOU NEWS AT YOUR FINGER TIPS

FOR FURTHER INQUARY, CONTACT US
+2347035262029


EMAIL bayelsanewmediateam@gmail.com OR Admin@bayelsanewmediateam.com,
saint@bayelsanewmediateam.com,
WEBSITE: www.bayelsanewmediateam.com